The Gist Lounge

Directions

The Gist Lounge Contact information, map and directions, contact form, opening hours, services, ratings, photos, videos and announcements from The Gist Lounge, Lagos.

📰 Welcome to The Gist Lounge! ☕
Your daily stop for trending stories, hot gist, entertainment, lifest✨ Daily gist, hot tea & good vibes ☕
😂 Funny • Relatable • Trending
💬 Come for the gist, stay for the laughs.
👇 Follow and don't miss the next update!

11/09/2026

Omo, kasala don burst oo!
​Ex-BBNaija winner Whitemoney don reset actor Uche Maduagwu gear after Uche open mouth call am "OSU"—say even the movie "Properties of the Gods" na Whitemoney real-life story.
​Whitemoney, block-head no dey, initially talk say body go tell Uche for court for defamation. But e look like patience finish! Dem catch two of dem for street where Whitemoney and him bouncer rearrange Uche with better beating for public view.
​No lie, dis internet dragging don turn physical hand-to-hand combat! What's your take on this drama?

11/09/2026

Human heart too dark! Pikin suppose feel safe with her own papa, but na him come be the monster. Maximum sentence no even reach for dis man.One useless father don open mouth confess after dem catch am say he dey sexually abuse him own biological daughter, come even dey yarn say, "Na this year I start to f*ck am."

11/09/2026

One Nigerian man don express serious vexation concerning how health system for this country dey crash every single day.
​The man carry him pikin go Federal Medical Centre (FMC) for Abeokuta, Ogun State, make doctor check the boy ear. But wetin him eye see, him mouth no fit talk finish!
​For inside video where him drop online, the man say shock catch am after hospital give am appointment to come back on October 2, 2026—even though he carry the boy go hospital on September 10!
​He come display the hospital card on camera to show the October 2 date, dey wonder why them no fit treat his son quick-quick.
​Hear am for the video: "Imagine say you carry your pikin come Federal Medical Centre here for Abeokuta to treat am for anything. I bring my son make them check him ear, dem dey tell us make we return October!"
​The angry papa come call out Federal Government make dem fix health sector sharp-sharp, say country hard already and Nigerians dey bleed under dis economic condition, make hospital wahala no come join am.

10/09/2026

Omo, wahala dey o! One man don open mouth drag people full everywhere.
​E say na big elders even dey show shame pass pikin these days. The guy paras for people wey troway pride go line up dey hail and welcome First Lady Remi Tinubu as she land Imo State, despite as country red and heat dey everywhere so! E say: "With all this shege wey everybody dey face, na First Lady visit una still dey go celebrate?"

10/09/2026

Omo! One person for online don post video show the kind tear-down, rickety bus status where Lagosians dey enter, and how government or LASTMA even let the motor dey ply road for Eko.
​Naija people sha! No matter how the bus be, once driver say "Oshodi, enter with your change," people go still jam inside!

10/09/2026

Omo, see wahala o! Lagos State government don start to pull down all those illegal "self-contain" apartments under bridge.
​The main gist be say people actually build rooms live inside, dey tap light illegally, and even convert the place to big warehouse under public bridge!
​But the real question wey everybody dey ask now be say: How dis whole setup take happen for how long, and where government officials bin dey look since all dis while?

09/09/2026

Omo, see latest update! Nigeria first openly gay couple done run come online dey cry for help. Dem say dem and dem life no safe at all again, as family, neighbors, and even workmates dey drag and threaten dem. Now dem dey beg Nigerians to support dem make dem fit japa leave the country clear.

09/09/2026

Omo! Northern people don vex enter street today, dem say dem no dey do again with Tinubu government, so dem come out in dem numbers go protest for street!

09/09/2026

Omo, clear road! See wetin small pikin mouth bring drop for house! One small boy don expose his papa red-handed after e catch the man dey rest his head on top one strange woman heavy chest.
​As the boy dey give his mama full update, e tell am say: "Mummy don't cry o"—then e give the mama piece of advice say make she go do surgery or find way pump her own bobby, say e too small and e supposed big pass like dat!

Address

Lagos

Website

Alerts

Be the first to know and let us send you an email when The Gist Lounge posts news and promotions. Your email address will not be used for any other purpose, and you can unsubscribe at any time.

Shortcuts

Share